+OK
Thursday , 14 November 2024
Home +OK News +OK Nigerian Woman Dumps Her Little Child By The Roadside After Pastor Told Her It Was A Snake In Delta State

Nigerian Woman Dumps Her Little Child By The Roadside After Pastor Told Her It Was A Snake In Delta State

According to facebook user apele Oghenek who posted these 3 photos:

SAPELE\DELTA STATE MUST BETTER.
03/04/2017.
WHO TO BLAME?
If I talk about men of God,some persons here go carry cutlass for my neck,like say na all men of God,nai God call.
Make I nack unu this very short story make only unu tell me who dey wrong before I go use am do post by 3pm about wetin I think about this people wey involve.
We all know say na women nai go Church pass and na dem nai still dominate marine world and coven. Where problem nor dey,only some women go use deir legs go find trouble put,after them go dey catch witch.
Yesterday early morning at about 4:30am for “Green Egbedi by Reclamation road”,nai dem see one baby for d junction dey cry seriously. As God go do am,dem cum carry the pikin go Police Station,go register the case and make complain.
Na later in the day,dem cum see d mother of the baby,wey cum talk say,na one pastor wey get Church for cemetery by palace hotel,nai tell her say,her pikin na snake and make she bring N52,000. So that he fit pray for the baby and d baby go dey better.
The name of the woman na Amara Emeka and she dey stay macphason by Komi Rd. Na the Pastor talk,nai put fear for her mind,wey make her go drop the woman for the junction,so that the baby go cry die or make dem carry the baby go Madam Buwa easily, becos she nor fit raise the N52,000 to give her man of God.
Make we all nor look this matter throway face, becos e good make we pour out our mind,for others to learn from.
According to Tafia Keneri,e say some Pastors dey use bottom power take dey talk with deir members and e dey make the members dey fall victim to anything dem tell them. Keneri say na charm some Pastors dey use.
Marian Jasper talk say,she nor believe the woman,say she dey lie and also talk say,if she nor want the pikin,why she nor throway her for other places,wey e be say,na where eyes go quick see d baby and na make dem for pity her,make her go dump d baby there.
We for studio don think this matter pass different angle,nai make we say make we hear unu version.
I Remain The Otota1 Of Sapele.
The Ukpe1 Of Okpe Kingdom.
The Asamaigor1 Of Warri Kingdom.
The Eagle Eyes Of Delta State.
God Bless Sapele.
(NA THE WOMAN PICTURE AND THE PASTOR CHURCH BUILDING AND BANNER DEY ATTACHED TO THE UPDATE.)
If u blame the Pastor say Hi and give ur reasons.
If u blame the woman say Nil and give ur reasons.
SAPELE\DELTA STATE MUST BETTER.

Comments

comments

.

Официальный сайт Вавада казино всегда доступен через рабочее зеркало. Клуб Vavada предлагает отличные бонусы за регистрацию, которые помогут вам увеличить шансы на выигрыш. Играйте в лучшие слоты прямо сейчас!

+OK